Skip go main gist
✍🏾
GIST WEY JUST LAND
Read am for:

Moove Don Follow Uber Carry Their Load Commot Naija As ProTaxi Touch Ground!

Just as some of us dey lock ourselves inside room dey design fresh rider, driver, and admin dashboards to fix this mobility matter, the market itself dey shake. Moove don finally pack their load follow Uber exit the Nigerian space. But as one door dey close, another one dey open—new player, ProTaxi, don enter the streets to take over. The hustle for who go control Naija mobility never finish!

Adebayo Adeyemi

4 days wey pass · 2 min to read

Eye dey here 11 Talk your own 0
Share this gist:
Moove Don Follow Uber Carry Their Load Commot Naija As ProTaxi Touch Ground!

Moove Follow Uber Run Commot Naija, But Dem Dash Drivers ₦35 Billion Worth Of Moto! 🚗💨

The mobility market for Naija dey do somehow right now. Barely one month after Uber pack their load comot, Moove—the vehicle financing giant—don announce say dem too dey exit the Nigerian market. But wait o, their own exit no be the normal 'lock shop and run' style; e come with massive giveaway!

The ₦35 Billion "Thank You"
Instead of seizing vehicles or auctioning them, Moove say dem dey transfer full ownership of eligible vehicles—wey worth around ₦35 billion—to their existing customers. From October 1, 2026, these drivers no need to pay Moove any shishi again for the cars. As if that one no reach, Moove say every single staff member go collect one free car as appreciation. Opor!

Co-Founder and Co-CEO, Ladi Delano, talk say the decision na to show gratitude to the Nigerian customers and staff wey support dem when the business be just ordinary idea. “Nigeria is where Moove began, and everything we have built since carries something of Lagos with it,” e explain.

From Lagos to the World (The "Serious Facts")
Make we look the numbers. Moove start for Lagos in 2020 with just 76 vehicles because Delano and Jide Odunsi see the pure shege mobility entrepreneurs dey face to get vehicle finance. Today, that small idea don turn global Unicorn. Dem recently raise $250 million Series C funding (wey make dem worth $2.1 billion) and dem now operate about 42,000 vehicles across 29 cities globally.

Before this their planned exit, over 9,000 Naija customers use their "Drive to Own" and rental products to generate a massive ₦57 billion in revenue. These are real people earning and supporting their families.

Why Everybody Dey Run?
Uber don go. Now Moove don follow. This back-to-back exit dey raise serious questions about the harsh operating conditions, commercial pressures, and how sustainable mobility business actually be for Naija right now.

Enter ProTaxi (The New Blood)
As the big boys dey leave, nature no dey allow vacuum. New player, ProTaxi, don step inside the arena to take over the e-hailing space. But for dem to survive where giants dey run, the strategy has to be completely different.

This is exactly why anybody launching into this space now must get their systems 100% right from day one. To win this market, you need rock-solid infrastructure—from a seamless rider app to highly optimized driver and administrative dashboards—that can balance cheap fares for customers with actual profitable earnings for the drivers.

The old guard might be leaving, but the floor is now wide open for new operators to test fresh approaches and solve Naija's transportation puzzle.

This gist sweet you? Show am love 👇🏾

Eye dey here 11 Talk your own 0
Send am give your people:

Enjoy this gist? Make e dey land for your inbox.

💬 Talk your own

…

Be calm o. No insult, no spam. Oga fit hide bad talk.

    More gist like this

    Show me everything →

    Nigerian Startup BoominSquare Dey Build One Digital Ecosystem for Shopping, Travel and Everyday Services

    BoominSquare dey position itself as more than an ordinary e-commerce platform, combining online shopping, order tracking, travel bookings, utility payments, and business management tools under one digital ecosystem. The platform also aims to help Nigerians abroad pay for essential services back home, while giving businesses digital storefronts and tools to manage orders, track performance, and expand their operations

    Adebayo Adeyemi4 min to read
    1 Laugh13 Eye dey here0 Talk your own

    I created a Spend Tracker feature for OPay

    Since OPay and other apps no get feature to track expenses, I don design my own Spend Tracker prototype to solve the problem. The feature go help you divide your money into categories so you go know exactly wetin dey chop your funds every month.

    Adebayo Adeyemi1 min to read
    0 Laugh9 Eye dey here1 Talk your own