Work With Us
Come Build Africa Tech Media With Us.
We be small team wey dey do big work. If you sabi tell story, design, make video or grow community, and you love African tech, we wan hear from you.
Who we dey always look for
Writers & Reporters
You fit dig gist, confirm facts and write am make person laugh small.
Content Creators
Short videos, memes, carousels. You fit turn tech news into content wey people go share.
Designers
Graphics, illustrations and magazine layouts wey get Naija flavour.
Partnerships & Growth
You sabi talk to brands and grow audience without wahala.
How we dey run things
- We dey work remote, from anywhere for Africa.
- We value people wey dey deliver, ask questions and no dey form.
- Your work go show for our site with your name and photo. We dey give credit.
How to apply
No open role for now? Send am anyway. Email us with:
- Small intro about yourself and the role wey you want
- Two or three samples of your work (links fit)
- Why WetindeyTech
Ready? Send your gist.
We go read every email. If e fit, we go reach out.
Apply by email β