I Don Design Spend Tracker Feature For OPay! π±πΈ
Around February this year, I bin dey find one app wey go allow me divide my money into different categories so I go fit track wetin exactly dey swallow my funds.
I check my favourite fintech app, OPay, but the feature no dey there. I check PalmPay, dem no get am too. I come download Piggyvest, but NIN wahala no let me rest. I just free the whole financial accountability matter that time.
But as a product designer, I come reason say why I go dey wait? So I sit down prototype a feature wey go completely close that gap.
See how e dey work:
With this Spend Tracker, you fit allocate any money wey enter your account (or your OWealth balance) into categoriesβlike food, data, transport, or investments. Then, anytime you wan do transfer, you just select wetin you dey pay for.
By the end of the week or month, the app go show you the exact thing wey chop your money pass, so you go fit adjust your budget for the future and stop to dey ask yourself "Where my money go?"
OPay, over to una o! π
Enjoy this gist? Make e dey land for your inbox.



