Before AI even start to make noise, Mark Zuckerberg carry like $80 billion go pour inside "Metaverse" just because e wan make people connect inside virtual reality. Omo, di thing flop scatter! Di corporate vision crash like cheap server. But guess wetin? Dat same Metaverse dream wey Mark dey find up and down don finally happen inside one mobile game wey Naija boys build for Naija people. Virtual world where things get real-life value no be corporate fantasy again. E dey happen live and direct inside Lagos Life, and na di rugged, vibrant spirit of Eko dey power am.
Di biggest proof say virtual world don finally merge with real-life economy happen yesterday. One professional therapist for X (Twitter) wey dem dey call @mrhighfoster (Vincent The Therapist) log enter di Lagos Life app. He no go there go catch cruise o, e go hustle! E run full therapy session with client inside di game using just voice note and text.
Di client totally refuse make dem move go WhatsApp, Zoom, or Google Meet. Dem prefer to hide behind their game avatar. Dat cover make dem feel safe to pour out their heart without fear or shame. For society where people still dey fear to talk about mental health, dis game just become di perfect hiding place. No need to sit down for physical hospital waiting room or fear face-to-face video call.
How di money take drop na di real Metaverse magic. Dem first start with short free session. Di client enjoy am well-well, come tip the therapist a whole 2 billion in-game tokens (you know how di game currency be na). But when e reach time for the real detailed session, di main payment bypass virtual world and land gbosa! straight inside di therapist real-life OPay account.
Dis na exactly wetin Zuckerberg and tech giants dey look for! Dem spend years trying to force people to do real business inside virtual space, but dem fail because dem build structure first and pray make culture follow. Lagos Life do am the other way round.
Shalom Rayhamen wey build am just carry the raw, colorful, and rugged Lagos street put inside game. One million people rush am within days! When you log in, you no dey see one clean, boring corporate office; na real Lagos you go face, complete with crazy Danfo drivers, stubborn agberos, and wicked traffic go-slow. Na because the game too authentic make people dey organically run real business inside.
Investors don shine their eyes see the heavy potential. Right now, Lagos Life don cash out $500,000 pre-seed funding, taking their valuation to a whopping $10 million! Who bring the money? Heavyweights like Flutterwave CEO Olugbenga Agboola (through Resilience17), tech veteran Oo Nwoye, plus the CEOs of Terra Industries and Mono.
Dis $10 million valuation na massive win for game wey dem say e take Rayhamen less than 12 hours to first build. With dis fresh $500k, dem go upgrade their servers, expand their infrastructure, and push the game far beyond just viral hype. Mark Zuckerberg, you dey see your mate?
Enjoy this gist? Make e dey land for your inbox.

